Nothing Dey Spoil For God Hand Lyrics by Timi Dakolo

Nothing Dey Spoil For God Hand

Read ‘Nothing Dey Spoil For God Hand Lyrics,’ by Timi Dakolo below

people dey ask me sey, wetin dey make me shine
wetin dey give me joy like this, wey I dey jump and shout.
people dey wonder why, why I still dey smile
in this crazy, crazy times, nothing dey touch my side.

when I try to dey fix am,
when I been try to dey run am,
e no work, e no work for me

when I try to help myself,
I realize sey no be by sense
na him I drop am for God hand oh

Because nothing they spoil for God hand oh (nothing they spoil for God hand oh)
Because nothing they spoil for God hand oh (nothing they spoil for God hand oh)
if you give am, E go keep am
if you spoil am, E go fix am

people dey ask me sey, wetin dey give me vibes,
where I dey get this energy,
when things dey fall apart (when things dey fall apart e e)

people dey wonder how, how I still dey smile
through this dark and lonely night, my light still dey shine.

I take my problem, leave am for God hand
the one wey pass me, na there I drop am oh
na so I do am oh

I take my problem, leave am for God hand
the one wey pass me, na there I drop am oh
I leave am for God hand oh

Because nothing they spoil (nothing they spoil for God hand oh)
Nothing they spoil for God hand oh (nothing they spoil for God hand oh)
if you give am, E go keep am
and if you spoil am, E go fix am

Because nothing they spoil for God hand oh (nothing they spoil for God hand oh)
Nothing they spoil for my God hand oh (nothing they spoil for God hand oh)
if you give am, E go keep am
and if you spoil am, E go fix am

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Recent

Popular

Trending Now Top 50